‘My Oga on top,
Make you chop so me sef fit chop
Nor finish the water for my cup
Or wetin I go drink if you nor stop?
My oga on top,
nor drive pass my bus stop
becos you dey Aso Rock.
Nor forget say me sef wan chop
from dat national sower sop.
My oga on top,
Nor chop cake come give me lollipop
Or else your show go flop.
I don warn you, my oga on top.’
This poem is written by Charles Novia, an award winning movie director, producer, author and record label owner.
My people this poem make sense ooo. Abeg, wetin una think?
No comments:
Post a Comment